24/12/2025
"I BUY AGBO TO SAVE MY MARRIAGE, NOW I DEY SEE GHOST... ADMIN HELP ME!"
Admin abeg hide my ID, make my church members no see me finish. Matter don pass my power. π©ππΎββοΈ
I be 35-year-old man, happily married for 3 years now. The issue start when stress for work begin affect my performance for "ze oza room." My madam start to complain say I too dey weak. As a sharp man, I no wan make another man help me
do my job, so I decide to find solution.
One evening, as I dey come back from work inside traffic, I see one old woman wey carry tray of Agbo bottles on top her head. Something just tell me make I call am. I explain my weak body give am (code language). The woman look me, shake head, come bring out one dirty-looking bottle wey get different roots inside.
She tell me say: "My pikin, this one na 'Odogwu Silencer'. If you drink one shot, you go perform like horse. But hear me warning o... NEVER drink am if you never chop, and NEVER allow woman touch the bottle."
I pay am 5k sharply. I reach house, I hide the bottle inside my shoe rack where my madam no go see am. That night, I drink one shot. My brothers, the power wey
come my body ehn, I nearly tear net! My wife confirm am, she even cook better soup for me next day.
Here is where the wahala start. π
This Agbo sweet me so tay I begin drink am every night for 2 weeks. I no know say addiction don start. Last Tuesday, I rush go work, I forget to hide the bottle well.
When I come back, I meet my wife for parlor. She dey hold the bottle. She dey cry. She ask me why I dey drink "Kayamata" to lock her destiny. I shout say no be Kayamata, say na waist pain Agbo. Before I fit collect am, out of anger, my wife open the bottle, pour the remaining Agbo inside sink, come smash the bottle for ground.
Admin, since that bottle break, my house never settle.
That night, as we sleep, I start to hear that old woman voice for my ear say "You break the covenant... you owe me payment." I wake up sweating. I look my wife side, my wife dey sleep but her eyes OPEN wide dey look ceiling, and she dey smile one kind wicked smile wey I never see before.
For the past 3 days now, whenever I touch my wife, my body go cold like ice water. The "manpower" don vanish totally. But the worst part be say, my wife don suddenly get energy. She dey lift heavy generator alone, she dey eat eba 6 wraps per sitting, and sometimes I dey see shadows dey walk follow am for house.
Yesterday, I run go the spot where I buy the Agbo to find the old woman. I ask the agbero for there. The Agbero look me like mad man, tell me say: "Oga, nobody dey sell Agbo for here since last year when one old woman motor jam die for this junction."
My head swell immediately.
Right now, I dey my office, I dey fear to go house. I no know if na spirit I buy Agbo from, or if na the Agbo turn my wife to something else. I love my wife, but I dey fear her now.
RNG Family, abeg wetin be the way forward? Make I carry my wife go church, abi make I go find native doctor wash my head? Who I go explain this kind thing give?